[MUSIC] Burna Boy – 20 10 20


African giant, Burna Boy has released a heartrending single dubbed ’20 10 20.’

On the song ’20 10 20′ Burna Boy talks about the Lekki massacre that took place on 20th October, 2020 where men on military uniform shot peaceful protesters.
However, the heartrending song was dedicated to the victims of Lekki massacre.

May the souls of the victims of Lekki massacre rest in peace.

Listen and share your thought below


Shey you never hear
about the things wey happen there Abi your eye never clear
Mankind so wicked
lets talk about my government open your mind and your ears Wetin happen
shey na jazz o
make my people suffer suffer All their nyanshes don dey open Everything don scatter scatter

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so WATER OOO WATER runaway my eyes Nothing you go talk wey go justify the case of their murder
The chief of staff, the commander and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo IJOBA
All your atrocity
All of your corner corner
Make all the DEADBODY disturb you for your dream

The money wey you thief yapa for your azza You don turn our graduates to common beggars All the book them go no matter
Cuz you no go get job if you no know godfather

The Chief of staff, the commander and the army wey carry order
Mr President, Mr Governor
Godfather, gbo gbo IJOBA
All your atrocity
All of your corner corner
Make all the DEADBODY disturb you for your dream

20th of October 2020
You carry army go kill many youth for Lekki
Na so WATER OOO WATER runaway my eyes Nothing you go talk wey go justify the case of their murder

We give them many chances Dem FAIL my people
And When we cry for justice Them kill my people
Walahi ALL of YOU
Their lives are on you
We no go ever forget all the youths Wey die for TOLLGATE

========================================== Promote Your Song & Video with Us Now At Affordable price Mail us now [email protected]

Post a Comment

0 Comments